FBI extradite Nigerian on dia most wanted list from Ghana for 'yahoo-yahoo'

Source: TodayFeedsMedia

Image
Di Federal Bureau of Investigation (FBI) don extradite one Nigerian wey dey dia Most Wanted Cyber Criminal List go Nebraska, for US.

Di FBI for statement tok say dem extradite 37-year-old Abiola Kayode wey bin hide for Ghana go di district of Nebraska to go ansa to accuse of cyber fraud.

Di authorities allege say Kayode bin participate for inside one yahoo-yahoo business wey defraud pipo for Nebraska and oda places of more dan $6 million (N9,307,380,000.00).

"Kayode, wey dey on FBI Most Wanted Cyber Criminal List, dey alleged to follow for one Business Email Compromise (BEC) scheme from January 2015 to September 2016. Di BEC scheme bin scam businesses for di District of Nebraska and elsewhere of more dan $6 million."

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post

Na for August 2019 for Omaha, Nebraska, authorities bin first file Conspiracy to Commit Wire Fraud Indictment charges against Kayode.

For April 2023, law enforcement authorities for di Republic of Ghana bin arrest Kayode according to one U.S. request for im extradition.

FBI explain say Ghanaian authorities grant request and surrender Kayode to FBI special agents wey bring am to di District of Nebraska.

Kayode bin get initial appearance on di Indictment on December 11, 2024. United States Magistrate Judge Michael D. Nelson bin order say make Kayode remain for detention pending trial.

Image
FBI accuse Abiola Kayode of $6m cyber fraud indictment.

According to di accuse, pipo wey Kayode and dem bin togeda dey run di business go pose as chief executive officer, president, owner, or oda executives of di targeted company to do dem wayo.

"Dem go use e-mail accounts wey be like say dem be di company true business executive, Kayode co-conspirators go ask di business employees or recievers of di e-mail to complete wire transfers. Di business employees, wey believe say di requests dey legal, go follow di wire transfer requests and send di money." Di statement tok.

Dem allege say na Kayode dey provide bank account information give di co-conspirators wey dey send d fake e-mails, and na im dey direct di business employees to wire money to accounts wey im and odas dey control.

"Dis bank accounts mostly belong to victims of internet romance scams, wey Kayode pipo instruct to transfer di funds to oda bank accounts," FBI tok.

FBI tok say dem don already convict and sentence some of Kayode co-conspirators.

Dem sentence Adewale Aniyeloye, one of di fraudsters wey dey send di fake e-mails to di target business for February 2019 go 96 months imprisonment and dem order am to pay $1,570,938.05 in restitution.

Pelumi Fawehinimi, one bank account facilitator, dey sentenced for March 2019 to 72 months imprisonment and court order am to pay $1,014,159.60 in restitution.

Onome Ijomone, wey be romance scammer, bin dey sentenced for January 2020 to 60 months' imprisonment and court am order to pay $508,934.40 in restitution afta im successful extradition from Poland.

Dem sentence Alex Ogunshakin, one co-conspirator wey provide bank accounts for di scheme go 45 months imprisonment for October 2024 afta im successful extradition from Nigeria.

Oda co-conspirators still dey at large.

https://bbc.com-fbi-extradite-nigerial-on-dia-most-wanted-for-ghana-for_yahoo-yahoo/

Comments